Pages

Wednesday 9 January 2013

LAIF FO HIA



...a poem in Naija Languaj (Nigerian Pigin)

A de awek
Til de brek

Na im a pik mai fon
Se mek a tok tu mai oun

Wetin a hia na dat vois
We pesin no fit si in fes

'The number you are calling
Is not responding'

Na im a veks
Wich kain tin bi dis

PHCN no de giv os lait
Tu ivun get wata man pikin must fait

Moni no de fo poket
Fud sef de had tu get

Bad rods de evriwia
Nau netwok pipul tu don kom ad dem own fo dia

Wi no de enjoi enitin fo dis kontri
Evri de na so so stori stori

A beg a don taya
Dis kontri de on faya

Wi de sofa no bi smol
Laif fo hia no de izi at ol

No comments:

Post a Comment